Israel pipol gada kon ready diasef; dem mash go kamp for two group kon face Siria pipol. Israel pipol bi like small-small goat, bikos Siria pipol plenty kon full evriwhere for di kountry.
Wen Gideon rish der, e hear one man dey tell en friend about di dream wey e dream kon sey, “I dream sey, bread wey nor get yist roll enter awa kamp kon nak and skata awa tents for groun.”
By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.
Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.