Wen Israel pipol kry give God make E help dem, God kon send one man among dem wey save dem. En name na Otniel wey en papa na Kenaz wey bi Kaleb yonga broda.
So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave.
Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’