Den Gideon tell God, “Abeg! Make Yu nor vex for mi sey I still won tok, bikos I still like do one test with di wool and dis time, I like make di wool dey dry, while di groun go soak with wota.”
One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill.