25 Dat nite, God tell Gideon, “Make yu take yor papa melu and anoda seven years melu, den distroy and skata yor papa Baal altar and di Asherah juju wey dey near am.
So Jakob tell en hold family and doz wey dey with am sey, “Make una skata all di oda gods wey dey with una. Make una go wosh unasef kon shange una klot.
Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.
“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
Den, yu go build betta altar for di Oga yor God on-top dis hill. Afta yu don build di altar, yu go take di sekond melu kon burn am as ofrin for di altar and yu go use di Asherah juju pole wey yu skata, take do firewood.”