Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 6:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 6:19
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E kon sey, “My oga, make una nor pass my house without sey una nor stop; I bi una savant.


I go still bring some food kom make una chop, so dat una go get pawa to kontinue una journey. Una don respet mi to kom my house, so make I serve una.” Dem kon ansa, “Tank yu; wi gri.”


“ ‘If di ofrin na bread wey dem bake for oven, den dem must nor make am with yist. E fit bi tick bread or biscuit wey dem make with flower kon mix am with olive oil.


Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”


As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun.


Abeg, make yu nor komot until I bring food kon offa give yu.” Di angel ansa, “I go stay here until yu kom.”


Di angel tell am, “Make yu put di meat and di bread for dis rock, den pour di oil on-top.” So Gideon do as e tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ