Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 5:8
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.


Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.


But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.


Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.


Make una listin, doz wey dey near di well dey sing, bikos God and Israel pipol don win! Den God pipol go mash kom from dia towns.


Na only few pipol remain for Israel village, until Deborah kom stand as Israel pipol mama.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ