4 My God, wen Yu komot from Seir go Edom, di eart shake and rain start to fall from di sky;
and e tell dem sey, “Make una tell my oga Esau sey: Dis na wetin yor savant Jakob tok, ‘I don dey stay with Laban since kon rish naw.
Den di eart bigin shake dey fear, di sky foundashon bigin shake too, bikos God bin dey vex!
God wey shake di eart komot from where e dey! E shake di pilas wey support di eart.
My God, na Yu make rain dey fall for yor pipol land. Wen yor pipol don taya, na Yu dey give dem pawa,
Rain fall kom down from di kloud and tonda nois full di sky, den yor arrow with lite kon dey shine.
Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.
Wi bi yor own from biginnin; but Yu neva rule dem before and nobody don ever koll dem with yor name.
Den di mountins go melt under en leg like kandol wey melt for fire kon rush enter di valley like wota wey dey rush kom from hill.
“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.
For dat time, en vois dey shake di eart, but naw, E don promise sey, “Nor bi only dis eart I go shake, but I go shake di heavens too.”