Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 5:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Una wey bi king, make una listin! Una wey bi rulers, make una hear mi! Bikos I go sing and play music give God, di Oga for Israel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 5:3
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“I go make rain fall for di eart wey go distroy evritin wey get life under di sky. Evritin wey dey di eart go die,


“Si! I dey make my kovenant with yu and yor shidren-shidren


Elijah kon tell dem, “Na only mi bi God profet wey remain, but Baal profet na 450.


E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”


E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve. But Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too.”


I kommand sey make all di ofisas wey dey keep money for West Eufrates aria provide for Priest Ezra wey know God for heaven law. Make una give dem


I go speak to kings about yor laws and I nor go shame.


I go praiz God as long as I dey alive. Even if I dey die, I go sing praiz to God.


Den I go win my enemies wey gada round mi! I go offa sakrifice for dis temple and shaut for joy! I go dey sing and praiz my Oga God.


Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.


I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do:


I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.


Heavens make una listin to mi as I dey tok; eart make una listin to di words wey I won tok so.


Bikos I go tok about God name and how E dey strong!


Na only few pipol remain for Israel village, until Deborah kom stand as Israel pipol mama.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ