Den e go meet di town pipol with en plan, so dem kut Sheba head kon trow am go give Joab for di oda side for di wall. Joab blow en trumpet take tell en men sey make dem leave di town and dem kon go house go meet di king for Jerusalem.
But as Sisera dey sleep, bikos e don taya well-well, Jael kon take hammer and nail waka small-small go near am kon nail en head from di korna join groun, so Sisera kon die.