24 Jael wey en husband na Heba wey kom from Kanaan, na-im dey bless pass among evry woman. Na Jael God bless pass all di wimen wey dey stay tent.
E bless Abram kon sey, “Make di Most High God bless Abram, di God wey kreate heaven and eart.
Make una reward am for evritin wey e dey do and evribody must praiz am for di town.
Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”
So Elizabet kon sey, “God don bless yu pass evry woman and E don bless di pikin wey dey yor belle!
By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.
Sisera tell am, “Abeg, make yu give mi wota drink, bikos my trot don dry.” So di woman gi-am milk from one leda bag, den kon kover am again.
Sisera ask am for wota, but e gi-am milk. E use fine bowl take bring di milk for am.