Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.
Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.
Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.
‘May bi dem dey divide di tins wey dem seize; dat is, one girl or two for evry man. Sisera dey gada fine klot; klot wey dem design well. Yes! Fine-fine robe wey dem design for di two side, dey join wetin dem seize.’