12 Deborah, make yu wake-up! Deborah, I sey make yu wake-up! Make yu wake-up kon sing song! Barak wey bi Abinoam pikin, make yu stand up go free doz wey dey prison.
God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!
Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land. Israel pipol go kom back to di land wey God give dem and pipol go serve dem. Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem kon rule di pipol wey bin sofa dem.
Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
Jerusalem, make una wake-up! Make una karry unasef up! Una don drink from di ponishment cup wey God give una, bikos E dey vex. Una drink am and e dey make una stagga.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.