Wen all di sheep don gada for der, di pesin wey dey guide dem go roll di stone komot from di well mout for di sheep to drink wota. Den, afta dem don drink finish e go put di stone back for di well mout.
I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.
E go give wisdom to doz wey dey judge, so dat dem go judge well. E go give strong heart to doz wey dey defend di town, so dat dem nor go fear any attack.
“Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok.
My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”
una must bring di two of dem kom di town gate kon stone dem die. Una go stone di girl die, bikos e nor kry wen di man dey sleep with am and una go kill di man, bikos e sleep with di woman wey en broda suppose marry; like dis, una go remove evil from among una.
Gad pipol take di best land for diasef; dem give dem di leadership. Wen Israel pipol leaders don gada, na Gad pipol dey first obey God kommand and rules for Israel.”
Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?