Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 5:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For dat day, Deborah and Barak, Abinoam pikin, sing dis song:

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 5:1
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:


Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”


All di men for Judah and Jerusalem kon dey happy as dem dey go Jerusalem and na Jehoshafat dey lead dem. God don give dem viktory ova dia enemies.


Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am.


wen doz wey dey stay heaven dey shaut for joy and for morning, di stars dey sing togeda?


My God, I love Yu well-well and na Yu bi my strent.


Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.


Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea.


Miriam sey, “Make wi sing to di Oga awa God, bikos E don win big war; E trow di horse and doz wey dey ride am inside di sea.”


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


For day time, pipol go sing dis song for Judah land: “Awa town dey strong well-well! God ensef dey defend awa wall and na-im dey make us strong!


Den Israel pipol kon sing dis song: “Make dis well kom up kon sing to God!


From dat time go, Israel pipol kon get pawa and strong more-more pass King Jabin, until dem distroy am finish.


Dat time, Deborah wey bi Lappidot wife, na profetes and judge for Israel.


Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ