Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.
But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.
I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”
Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men.
Yu yorsef go know sey today God don put yu for my hand for inside di rock. Some of my men sey make I kill yu, but I sorry for yu kon sey, ‘I nor go do bad tin to my oga, bikos na God choose am.’