17 By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.
God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.
So, make dia food tabol bi trap for dem! Make e bi trap for all doz dia friends!
Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.
Wiked pipol nor go ever get peace of mind.” Dis na wetin God tok.
For dat day, even di sojas wey strong well-well go drop all di tins wey e take dey fight kon run.” Na so Oga God tok.
But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.
Jael go outside go meet Sisera kon tell am, “My oga! Make yu kom inside my house. Make yu nor fear at-all.” So Sisera go inside, den di woman hide am kon take blanket kover am.
Jael wey en husband na Heba wey kom from Kanaan, na-im dey bless pass among evry woman. Na Jael God bless pass all di wimen wey dey stay tent.
For di time wey Shamgar, Anat pikin and Jael dey rule, pipol nor dey gri pass di main road and dem dey hide travel.