Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 4:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 4:16
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, make sinnas vanish komot from di eart and make wiked pipol disappear! Make my soul praiz God! Make wi praiz awa Oga God.


Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.


So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River, na so too Yu go do dem.


Di wota fall kover di shariot with doz wey dey ride dem and all Fero sojas wey porshu Israel pipol enter di sea, kon die.


Di One wey lead strong sojas go distroy Babilon, dia shariot and dia sojas. Dem fall for groun and dem nor go raiz again; dem dey go up like smoke wey dey kom out from lantan!


Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem.


Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.


God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.


God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish.


By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.


So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ