Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 3:3
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Zebulun go dey stay near di sea and e go dey kontrol many sheep for di sea, en land go long go rish Sidon.


Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.


For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.


Na Kanaan shidren-shidren Solomon use take do all dis work. Dis na di pipol wey Israel pipol nor kill wen dem kom out from Egypt kon take-ova Kanaan.


Di west boundary na from Mediterranean Sea go rish di nort side for west wey bi Hamat Pass.


Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”


and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad.


So make una get up kon kontinue una journey go Amor kountries for di hill; all di arias wey dey near der, di high lands, di Shefelah, di Negev, all di lowland, Kanaan and Lebanon, still e rish di great River Eufrates.


(Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir),


No town make peace with Israel pipol (escept Hiv pipol wey dey stay for Gibeon.) Israel pipol win all di remainin towns,


Kanaan pipol from di east and west; Amor, Hit, Periz and Jebus pipol from di kountry for hill and Hiv pipol from under Hermon for di aria wey dey Mizpa.


from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land


Gebal pipol aria and evriwhere for Lebanon for di east. From Baal-Gad; bottom Mount Hermon go rish Lebo-Hamat.


till e rish Abdon, Ebron, Rehob, Hammon and Kanah and Greata Sidon.


Israel men kon tell Hiv men sey, “E fit bi sey una dey stay near us. So how wi go fit make promise with una?”


Sidon, Amalek and Maon pipol, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom save una from dia hand?


So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem.


En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol.


So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.


E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before.


So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.


Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.


Filistia pipol leaders mash kom out with dia many-many sojas; so David and en men kon mash out with King Akish.


Di five Filistia pipol leaders dey wosh wetin dey happen, but dem go back to Ekron for dat same day.


Dem still bring gold rat for each towns wey di five kings dey rule; from di strong ones go rish di village dem, plus di Great Abel where dem put di Kovenant Box, until di day wey e rish Joshua (wey kom from Bet-Shemesh), field.


Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ