For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross.