But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
So Ehud waka go meet Eglon for where e sidan alone for one kool room for upstair, den e sey, “I get one message from God for yu!” As King Eglon get up from en chair,
Di swod enter di King belle well-well sotey e kover di swod head. So Ehud nor fit pul di swod komot from en belle and all di king intestine kon kom out.
Samuel kon sey, “Just as yor swod kill pipol shidren kon make some wimen nor get pikin again, na so yor mama nor go ever get pikin again.” Den Samuel kut Agag to pieces for God present for Gilgal.