Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
Dem from Efraim go di valley, di land wey bi Amalek pipol own before and dem follow Benjamin tribe with en men. Di kommanders kom from Makir and di ofisas kom from Zebulun.