Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 3:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 God Spirit enter am, so e kon bi leader for Israel. E go war go fight against King Kushan-Rishataim and God kon help Otniel, win am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 3:10
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.


Den Zekaraya wey Benaya born, God Spirit kon enter en pikin Jahaziel, for all di pipol present. Na Jeiel wey Matanaya born bi Benaya papa. Dem bi Levi pipol from Asaf family.


Nor drive mi komot from yor present or take yor holy spirit from mi.


I go kom down kon tok with yu, I go take some of di Spirit wey dey inside yu kon put am inside dem and dem go help yu karry some of di wahala so dat yu nor go karry am on yor own.


God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.


Moses ansa, “Yu dey jealous? I for wish sey God give en Spirit to all en pipol, so dat all of dem go dey profesai!”


As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.


God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


Wen pesin don first know di trut; taste God gift from heaven; know di Holy Spirit;


Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol.


So, Jeftah lead en sojas go fight Ammon pipol and God gi-am viktory.


God Spirit gi-am pawa and e dey stay for Dan wey dey between Zorah and Eshtaol.


At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.


At wons, God Spirit make Samson strong and e tear di lion with en ordinary hand like sey na small goat. But e nor tell en papa and mama wetin happen.


As Samson rish Lehi, Filistia sojas kom dey happy dey shaut. At wons, God pawa enter Samson and e kut di rope wey dem take tie am like sey na tread wey dey burn.


So peace kon dey di land for forty years. Den Otniel wey bi Kenaz pikin kon die.


So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.


Na wons God Spirit enter Gideon body, so e blow trumpet take koll all Abiezer family kom out make dem follow am.


Wen dem rish Gibeah, some profets kom meet am. Den God Spirit enter Saul body and e kon bigin tok like di profets.


Den God Spirit go enter yu and yu go dey profesai as dem dey do. Yu go bi like anoda pesin.


As Saul hear dis word, God Spirit enter en body and e kon dey vex.


So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ