Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 21:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 So Benjamin men go back to dia house and Israel pipol kon give dem di girls from Jabesh wey dem nor kill make dem marry. But dem nor many rish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 21:14
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.


For all di pipol wey dey Jabesh, dem si 400 yong virgin wey neva sleep with man before kon bring dem kom di kamp for Shiloh wey dey Kanaan land.


Di sojas wey remain na di six hundred wey run go Rimon Rock and dem stay der for four monts.


Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa.


Den di pipol send message go give di pipol wey remain for Benjamin tribe, wey dey stay for Rimon Rock.


Di pipol sorry for Benjamin pipol, bikos God don separate dem from di oda Israel tribes.


Den wen dia papa and brodas kom meet us with vexnashon, wi go tell dem sey, ‘Abeg make una sorry for us. Make una allow dem marry una dotas, bikos wi nor fit find wife for all of dem wen wi distroy Ramot. And nor-tin go do una if una break di vow, bikos una nor really marry una dotas give dem from una mind.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ