34 Na 10,000 special sojas wey dem choose from Israel tribe kon attack Gibeah. Di fight strong well-well sotey Benjamin sojas nor know sey dem go soon distroy dem finish.
True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.
So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
Wen Ai king si Israel pipol, en and all en sojas kwik-kwik get up di next day go fight Israel for Arabah. But Ai king nor know sey some men hide for di town back.