David tell di messenja, “Tell Joab make e nor fear or vex, bikos dem nor dey know who go die for war. Tell am make e attack di town well-well kon win am.”
Bikos dem don go Bethel go kry for God present till evening kon dey sey, “Make wi fight against awa rilative for Benjamin tribe again?” God ansa dem, “Make una go fight dem.”
David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.