Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 2:3
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den dem bigin woship dia juju and na dis make all of dem fall


Make dem nor stay una land, so dat dem nor go make una sin against mi, bikos if una serve dia gods, I go distroy una.”


“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol wey dey di land wey una dey go, if not, e go bi trap for una.


But if una nor drive di pipol komot, den dem go dey give una problem and dem go trobol una for di land.


All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.


den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.


I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.


Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry.


and dem marry demsef too. Israel sons marry Kanaan girls; while Israel girls marry Kanaan sons and Israel pipol kon dey serve Kanaan gods.


So Gideon make image with di gold kon put am for Ofrah wey bi en own town. Israel pipol forget God kon go der dey go woship di image. And e kon turn wahala for Gideon and en family.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ