den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.
For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”
Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.