Bad pipol dey opress dem since dem kom dis land, but e nor go happen again. I promise sey, I go make yu win all yor enemies and I go give yu many shidren.
so Yu kon allow dia enemies win and rule dem. But wen dem koll Yu for help wen dem dey trobol, Yu ansa dem from heaven. Bikos of yor great mesi, Yu send leaders wey kom save dem from dia enemies.
Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol.
But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift.
E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem.
For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.