Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 2:13
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go do dis tin, bikos Solomon rijet mi kon bigin woship oda gods. E dey woship Astarte wey bi Sidon juju; Kemosh wey bi Moab pipol god and Milkom, wey Ammon pipol dey serve. Solomon nor obey mi; e dey do bad tins and e nor keep my laws and kommand, just as David en papa keep am.


E bigin woship Astarte wey bi Sidon pipol juju and Milkom, di yeye god wey Ammon pipol dey serve.


Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.


Bikos dem nor dey follow God law again, for di fift year wey Rehoboam dey rule, King Shishak for Egypt kon attack Jerusalem.


E use en sons take do sakrifice for Ben-Hinnom Valley and na dis kind sins di nashons wey dey der before, dey do wey make God drive dem komot di land.


E build di high place wey en papa King Hezekaya skata. E make altars for Baal and Asherah juju. E bow and woship all di stars for di sky.


Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”


den dem bigin woship dia juju and na dis make all of dem fall


Den make yu tell dem, ‘God sey, “Na bikos una grand-grand papa rijet mi kon go woship oda gods. Dem forget mi and nor gri obey my law.


“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.


Bikos Israel pipol join dem woship Baal-Peor, God kon dey vex well-well for dem.


Dem dey koll many tins for heaven and eart, “gods and mastas,” but non of dem really bi god or masta.


Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.


Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.


Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju.


Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’


Dem put Saul swod for Ashtoret temple kon hang en body for Bet-Shan wey bi di town wall.


Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ