8 For di fift day, e kon kwik wake-up make e dey go. Again, di girl papa kon sey, “Make yu chop sometin; den yu fit go for aftanoon.” So dem sidan kon chop.
Afta, wen di man, en girl-friend and en savant dey ready to go, di papa kon sey, “Look, evening don almost rish. Make una stay and enjoy for dis nite, den tumoro morning, una fit get up early kon go.”