Afta, en brodas and family kon karry en dead body. Dem take am go beri between Zorah and Eshtaol, where dem beri en papa Manoah put. Samson lead Israel pipol for twenty years.
So Dan pipol choose five strong warrior from Zorah and Eshtaol town, so dat dem go find land where dem go stay. Wen dis men rish Efraim hill kountry, dem kon go stay for Mikah house till di next day.
So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.
Dem ansa, “Make una kom, make wi attack dem! Wi don si di land and e dey very good. Wetin una dey wait for? Make wi nor waste time, make wi go take am.