Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 18:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Di priest tell dem, “Make una go in peace, bikos God dey with una for di journey.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 18:6
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All di oda profets tok di same tin kon sey, “Make yu go attack Ramot for Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”


Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”


So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”


But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail.


Den Moses go back go meet en wife papa, Jetro kon tell am, “Make yu allow mi go back to my family for Egypt kon shek if dem still dey alive.” Jetro ansa Moses, “Make peace follow yu go.”


Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!


Make God awa papa and Oga God Jesus prepare road for us, so dat wi go si una again.


Den dem tell am, “Ask God for us weda awa journey go get head.”


So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.


Eli kon ansa, “Make yu go! Make peace follow yu and make Israel God give yu wetin yu wont.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ