8 E komot for Betlehem go look for anoda place where e go stay. Wen e dey travel, e kon rish Mikah house for di hill kountry wey dey Efraim.
Eleazar wey bi Aaron pikin kon die too and dem beri am for Gibeah for di hill kountry for Efraim, where en pikin Finehas for get land.
Di Levi man gri and e kon bi priest like Mikah pikin too.
One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.
Mikah ask am, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I bi Levi from Betlehem for Judah and I dey look for where to stay.”
For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.