12 So e stay Mikah house and Mikah kon make di man e own pesinal priest.
King Jeroboam still build one place on-top di hill sey make pipol dey kom woship for der and e choose priest from family wey nor kom from Levi tribe.
Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place.
God tell Aaron, “Yu, yor sons and yor tribe must sofa for di Tabanako sin; but only yu and yor sons go sofa for di priest sins.
Di Levi man gri and e kon bi priest like Mikah pikin too.
Den Mikah sey, “I know sey God go bless mi naw, bikos I get Levi pesin as my priest.”
Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin, dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go Babilon.
E ansa dem, “I get agriment with Mikah, to bi en pesinal priest and e dey pay mi.”