I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.
By dat time, Delilah hide some men for di oda room, den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu o-o!” But Samson kut di rope, just as tread dey kut if yu take fire tosh am. So dem nor still know di sekret wey make am get pawa.