Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 16:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 All di five rulers for Filistia go meet Delilah kon sey, “Make yu deceive Samson, so dat e go tell yu wetin make am dey strong and how dem fit take stop am. Den yu go find way take tie am with rope well-well. Afta evritin, each of us go give yu 1,000 one hundred silva.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 16:5
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am.


from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land


For di fourt day, dem kon tell Samson wife to bi, “Deceive yor husband to bi, so dat e go tell yu di ansa of wetin e tell us; if not, wi go burn yu and yor papa family togeda, bikos e bi like sey yu invite us kom here, so dat wi go dey poor.”


Afta sometaim, Samson kon love one woman wey en name na Delilah, wey dey stay for Sorek Valley.


So Delilah go meet Samson kon tell, “Abeg, make yu tell mi, ‘Wetin make yu dey strong like dis and wetin pesin go fit do, if e won tie yu?’ ”


One day, e tell en mama, “Yor 1,000 one hundred silva wey dem tif wey kon make yu curse di tif, dey my hand.” Na mi tif am. Den en mama sey, “Bikos yu gri sey na yu tif am, make God bless yu!”


Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.


So Akish kon tell David, “I swear with God wey nor dey die sey, yu dey loyal to mi and na mi go happy pass sey yu follow mi go fight dis fight. I nor si anytin wey go let mi blame yu since di first day wey yu dey with mi kon rish naw. But di oda leaders bilive sey yu dey pritend.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ