Many of dem don drink by naw, so dem sey, “Make una bring Samson kom out make e kon make us laf!” So dem bring am kom out from di prison and e stand between di two pila wey dey support di building. Dem kon dey play with am, so dat e go make dem laf.
By dis time, di temple don already full with pipol. All di five Filistia rulers dey der and about 3,000 men and wimen dey der dey wosh Samson as e dey make dem laf.