19 Delilah deceive Samson sleep for en lap, den koll one man make e kut di seven hair komot. Den e put am for groun small-small, bikos en pawa don leave am.
I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.
Delilah just know sey Samson don tell am di trut, so e send message go give Filistia rulers sey, “Make una kom back just dis last time, bikos e don tell mi di trut.” So dem bring di money follow body kom.
Den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu!” E wake-up kon tell ensef, “I go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga God don leave am.