Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 16:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Delilah just know sey Samson don tell am di trut, so e send message go give Filistia rulers sey, “Make una kom back just dis last time, bikos e don tell mi di trut.” So dem bring di money follow body kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 16:18
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am, bikos e dey sweet for body.


So di eldas for Moab and Midian kon karry di curse money go meet Balaam. Dem meet Balaam kon tell am wetin Balak tok.


kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am.


One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.


Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.


so e tell am di trut at last. E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”


Delilah deceive Samson sleep for en lap, den koll one man make e kut di seven hair komot. Den e put am for groun small-small, bikos en pawa don leave am.


All di five rulers for Filistia go meet Delilah kon sey, “Make yu deceive Samson, so dat e go tell yu wetin make am dey strong and how dem fit take stop am. Den yu go find way take tie am with rope well-well. Afta evritin, each of us go give yu 1,000 one hundred silva.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ