Den Delilah tell am, “Yu still dey lie and fool mi! So naw, make yu tell mi how pesin fit take tie yu.” Den Samson ansa am, “If yu plait my hair into seven part kon use peg take make am tit, I go dey weak well-well.” So wen Samson dey sleep, Delilah kon plait di hair into seven part.
Den Delilah vex kon tell am, “Why yu dey tell mi sey, ‘I love yu’ and yu nor fit trust mi kon tell mi yor sekret? Yu don fool mi three times naw and yu neva still tell mi wetin make yu dey strong!”