Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 16:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Den Delilah tell am, “Yu still dey lie and fool mi! So naw, make yu tell mi how pesin fit take tie yu.” Den Samson ansa am, “If yu plait my hair into seven part kon use peg take make am tit, I go dey weak well-well.” So wen Samson dey sleep, Delilah kon plait di hair into seven part.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 16:13
4 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.


Leta, Delilah kon tell Samson, “Si, yu dey lie for mi kon make mi bi like fool! Abeg, make yu tell mi di trut, na how dem fit take tie yu?”


So Delilah take new rope kon tie am. Di men dey di oda room dey wait, so e kon shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu!” But e kut di rope komot for en hand like sey na tread.


Den e tit am with di peg. E kon shaut again, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu o-o!” So Samson wake-up, remove di peg, den luz en hair.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ