2 Den di man tell Samson, “I bin tink sey yu hate my dota, so I kon gi-am to yor best man as en wife. But si, en yonga sista fine pass am well-well. Yu fit marry dat one.”
So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.)
So Samson wife to bi kry go meet am sey, “Yu nor love mi; yu hate mi! Yu tell my pipol sometin and yu neva tell mi di ansa.” But Samson tell am, “I neva even tell my papa and mama di ansa, so wetin go make mi tell yu?”