Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 15:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Leta, Samson kon dey hongry for wota, den e kry give God sey, “Yu give mi dis viktory finish, make dis wiked Filistia pipol kon katch and kill mi, bikos wota dey hongry mi?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 15:18
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Abraham ansa, “Bikos I feel sey nobody dey wey dey fear God for dis place and dem fit kill mi if I sey na my wife.


E nor fit waka well as e dey pass Penuel land, bikos of en lap wey dey pain am, so sun kon dey beat am.


Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.


Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).


Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets,


But en papa and mama nor happy. So dem ask am, “Yu nor si any woman wey yu like for awa family or di whole Israel wey yu fit marry? Why e bi sey na Filistia woman yu won marry?” But Samson tell en papa, “Make una go marry am for mi, bikos e look like betta pesin to mi.”


Afta e don boast finish, e trowey di bone kon koll di place, “Bone Hill.”


Den Samson pray give God sey, “Oga God wey get pawa, remember mi again. My God! Abeg make Yu give mi pawa one more time. Make I pay Filistia pipol back for my eye wey dem blind.”


For dis time, Gideon and en three hundred men don cross Jordan River. Dem don taya, but dem still dey porshu dia enemies.


David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”


Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”


David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ