7 Wen Samson rish Timnah, e go tok to di girl, bikos e like am.
At wons, God Spirit make Samson strong and e tear di lion with en ordinary hand like sey na small goat. But e nor tell en papa and mama wetin happen.
Leta, as Samson dey go marry di girl, e kon branch go look di lion wey e kill and e sopraiz to si bee and some honey inside di lion dead body.