4 En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol.
Na so God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house.
E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
Dis na how God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
God kon make Ahazaya kingdom skata, bikos e go visit Joram. Wen Ahazaya rish der, e kon follow Joram go meet Nimshi pikin, Jehu wey God choose to take distroy Ahab family.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
So 3,000 men from Judah go di kave for di rock for Etam, go meet Samson kon tell am, “Yu nor know sey na Filistia pipol dey rule us? Wetin yu do to us so?” Samson ansa dem, “I pay dem back for wetin dem do mi.”