Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 14:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So Samson tell dem, “Make I tell una one problem, if una fit solve am for di next seven days, I go give una thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 14:12
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E still give all of dem many klot, but e give Benjamin three hundred silva and five klot.


Wen di kween for Sheba hear about di wonderful tins wey Solomon dey do, e kon travel go Jerusalem go test am with hard-hard kweshon.


Gehazi ansa, “Yes! Evritin dey okay. Na my oga send mi kom meet yu sey, ‘Two of di profets savant just kom meet mi from Efraim hill kountry. So make yu give dem silva wey heavy rish seventy-five pounds and two difren klot.’ ”


Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot.


For dat time, Solomon and Israel pipol celebrate for seven days. Pipol from Hamat for nort go rish Egypt wotaside for sout, still dey join dis pipol too.


I go listin to many proverbs and play jita take solve many problems.


so dat dem go fit undastand proverbs, parabols and wetin wise pipol dey tok.


E dey make klot and belt kon sell dem give tradas.


“Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;


But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”


Naim make I dey tok with parabol sey: “ ‘Dis pipol get eye, but dem nor dey si, dem get ear, but dem nor dey hear or undastand.’


Jesus tok all dis tins for parabol to di pipol. Evritin wey e tell dem, na parabol e use.


Dem remove en klot kon wear am klot wey make am bi like king.


“Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem.


Wen Jesus si how di pipol wey dem invite dey rush to sidan for betta chair, e kon tell dem one parabol:


En disciples kon sey, “Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol.


Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.


Yor money don rotin and ants don chop yor klot.


Wen di girl papa si am, dem selet thirty men for di town make dem stay with am.


But if una nor fit solve am, una go give mi thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.” So dem kon gri.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ