I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.
Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.
So Samson tell dem, “Make I tell una one problem, if una fit solve am for di next seven days, I go give una thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.