Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know), e koll di man wey dey marry kon tell am sey,
Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”
E take some of di honey for en hand kon dey lick am as e dey waka go. Den e take some go give en papa and mama. Dem lick am, but Samson nor tell dem sey na from lion dead body e for take am.