Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name.
But e tell mi sey, ‘I go get belle kon born boy.’ E still sey, ‘Make I nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid, bikos from di day wen I go born di pikin go rish di day wey e go die, dem go dedikate am give God as Nazirite.’ ”