5 Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God as Nazirite. E go save Israel pipol from Filistia pipol hand.”
“ ‘As long sey dem don vow to bi Nazirite, dem must nor kut dia hair or shave am. Dem don bilong to God forever, so dem go dey holy and allow dia hair grow.
so e tell am di trut at last. E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”
So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”